JAMB don open up say kasala bin burst during the 2025 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME) wey make plenty candidates no do well as dem suppose.
Na the JAMB Oga Patapata, Prof. Ishaq Oloyede, talk this one for one press briefing wey happen for Abuja on Wednesday, May 14. E say dem go re-run another UTME for 379,997 candidates wey dey for five South-East states plus Lagos, because the gbege affect dem pass.
“What suppose be joy don turn wahala because of one or two errors,” Prof. Oloyede yarn. He come talk say na him carry the blame and na real "sabotage" happen for the UTME this year.
E still add say dem go begin send text message to the affected candidates from Thursday, May 15, make dem sabi when the new exam go happen.
“I no go lie, na me mess up, I carry the matter for head,” the JAMB boss talk. But him no still talk wetin exactly go wrong.
UTME na compulsory exam wey every student go write if dem wan enter university, polytechnic or college for Naija. The exam dey always get four subjects—English na must, then three others wey match wetin the person wan study.
JAMB release the result on May 5, and the thing shock people. Over 1.5 million from 1.9 million candidates score below 200 out of 400. Na like 79 percent fail like that. Only 12,414 candidates manage score 300 and above—na less than one percent of everybody wey write the exam.
This one provoke many people. Candidates and their family carry the matter go social media, dey drag JAMB say make dem check the result again. Some even carry the case go court.
Two days before the press briefing, JAMB don already talk say dem dey investigate the matter. Dem even gather experts from Computer Professionals Association of Nigeria, Vice Chancellors, educational gurus, and other ogbonge people to check wetin really go wrong.
JAMB don promise say dem go fix the matter sharp-sharp and make sure say everything clear for everybody wey write the exam.
Post a Comment