Di JAMB Oga, Prof Ishaq Oloyede, talk on Wednesday say na error cause di poor scores wey candidates from South-East states and Lagos State get.
JAMB come talk say dem don dey plan another exam for all di affected candidates.
But as di mata don hot, di National President of Ohanaeze Ndigbo Youth Council Worldwide, Mazi Okwu Nnabuike, yarn on Thursday say di idea of another exam no make sense at all.
According to am, “Na big wahala say JAMB wan carry our pikin go through another mental stress, tension and risk wey no be dem cause.”
E talk say:
“Make we talk am clear – our people no go gree do another exam. JAMB don already use fake result put dem for serious wahala. Di children mind no dey stable to do another exam now.
“Who go pay di transport and other cost? Na di same papa and mama wey no even get money to feed?
“How we go send pikin go write another exam when kidnappers full road? This na serious risk,” Okwu talk.
As e close mouth, Okwu demand say:
“JAMB suppose give all South-East candidates wey dem affect 300 score straight. Na dem make mistake – no be di children. Igbos dey sharp and fit score 300 and above on a good day.
“Dis na wicked plan to block education for South-East people.”
Okwu warn say if JAMB no do wetin dem talk, dem go carry JAMB go court. E talk say no amount of “crocodile tears” from di Registrar go save JAMB.
Post a Comment